Psalms 149pcm

1Make wi praiz di Oga wey bi awa God kon sing new song to am. Make wi sing praiz am for where en pipol gada put.

2Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.

3Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,

4bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef, E dey make dem win.

5Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem! Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!

6As dem hold swod wey get two mout for dia hand, make dem praiz God,

7so dat dem go fit revensh dia enemies kon ponish di strenjas.

8Dem tie dia enemies kings with shains and dia priests with iron

9and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 149.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.