Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 149

:
Nigerian - pcm
1 Make wi praiz di Oga wey bi awa God kon sing new song to am. Make wi sing praiz am for where en pipol gada put.
2 Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.
3 Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
4 bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef, E dey make dem win.
5 Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem! Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
6 As dem hold swod wey get two mout for dia hand, make dem praiz God,
7 so dat dem go fit revensh dia enemies kon ponish di strenjas.
8 Dem tie dia enemies kings with shains and dia priests with iron
9 and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!