Psalms 148pcm

1Make wi praiz God! Make wi praiz God from heaven! Make wi praiz am from di sky!

2Make all en angels praiz am! Make all di sojas for heaven, praiz am!

3Make di sun and di moon, praiz am! Make all di stars wey dey shine, praiz am!

4Make di sky, praiz am! Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am!

5Make evritin wey God kreate, praiz am, bikos E just kommand and evritin kon dey as dem dey.

6E put dem for where dem dey forever and ever. Nobody fit tok against en kommand.

7Make all di tins wey dey inside di sea and di ones for land, praiz God.

8Make big-big stones with fire, snow and kloud, wind and weda, obey am.

9Mountins and all di hills; trees and all di cedars;

10wild animals and ordinary animal; animals wey dey creep for groun and birds;

11kings for di eart and all di pipol; doz wey dey rule and judge di eart;

12yong men and yong wimen; old men and shidren, make all of dem praiz God.

13Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven!

14E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 148.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.