Psalms 147
1 Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!
2 God dey ribuild Jerusalem and E go bring en pipol kom back to Israel from di land where dem dey.
3 E heal pipol wey dia heart don break kon trit dia sore.
4 E dey kount and koll di stars by dia names.
5 Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!
6 God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey.
7 So, make una sing tank God; make una use harp take sing praiz awa God.
8 E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart, den E make grass grow on-top mountins.
9 E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry.
10 E nor kare about di pawa wey horse get or di one wey human being get.
11 No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.
12 So, Jerusalem pipol! Make una praiz God! Pipol for Zion, make una gi-am all di praiz!
13 Bikos E don make di iron for una gate strong kon bless all una shidren.
14 E send peace kom una land kon make una chop betta food.
15 E send en laws kom di world; so make una si as en word kwik kom meet una!
16 E send snow kom like as wool dey fall; E skata snow for groun like ashes.
17 E trow big-big stones with fire kom di eart. So, na who fit stand face God kold breeze wey fit turn pesin to ice-blok?
18 But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt. E send en breeze and di ice-blok kon turn wota.
19 E don show Jakob en word, kommands and rules for Israel pipol.
20 E neva do like dis for any oda nashon; no oda nashon know en rules and kommand. So make wi praiz God!