Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 146

:
Nigerian - pcm
1 Praiz God! My soul, make yu praiz God.
2 I go praiz God as long as I dey alive. Even if I dey die, I go sing praiz to God.
3 Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.
4 Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
5 But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.
6 Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.
7 Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison.
8 God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am.
9 God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.
10 So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God!