Psalms 146pcm

1Praiz God! My soul, make yu praiz God.

2I go praiz God as long as I dey alive. Even if I dey die, I go sing praiz to God.

3Make yu nor trust pipol wey get pawa; bikos dem nor go fit help yu.

4Wen dem don die, dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.

5But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.

6Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.

7Pipol wey dem dey opress, E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry. God dey free pipol wey dey prison.

8God dey open blind pipol eyes kon karry doz wey dey weak, go up. God love pipol wey dey fear am.

9God dey guide di strenjas among us. E dey kare for pipol wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.

10So God go rule forever. Jerusalem pipol, E go bi una God from one generashon go rish anoda. So, make wi praiz awa God!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 146.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.