1Solomon, David pikin wey bi king for Israel, na-im rite all dis wise word.
2E rite dem so dat pipol go get wisdom, undastandin and good advise.
3Dis words go tish una how to live betta life, to dey honest and to dey tok trut and korrect word.
4Dis words fit make pesin wey nor know anytin get sense and e go tish yong men how to work and get money.
5Make doz wey get sense listin to dis words kon wise more and make e guide doz wey get undastandin,
6so dat dem go fit undastand proverbs, parabols and wetin wise pipol dey tok.
7For yu to get wisdom, yu most fear God, but na only foolish pipol dey rijet wisdom and good advise.
8My pikin, make yu listin wen yor papa dey korrect yu and follow wetin yor mama dey tish yu,
9bikos wetin dem dey tish yu go bi like betta shain for yor neck and betta kap for yor head.
10My pikin, wen sinnas tempt yu, make yu nor fall for dem.
11If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem.
12If dem sey, “Even doh di pipol dey alive and okay naw, dem go die wen wi don deal with dem finish!
13Den wi go si plenty good tins karry kom awa house.
14So, kom join us make wi go divide wetin wi tif.”
15My pikin, make yu nor follow dat kind pipol or go near dem at-all.
16Bikos dem dey enjoy to do bad tin and dem always dey ready to kill.
17E nor dey good to set trap wen di bird wey yu won katch dey look yu.
18But pipol wey dey do like dat, dey set trap for demsef and na di trap go kill dem.
19Dis na wetin dey happen to pipol wey play wayo take get propaty.
20Wisdom dey koll pipol for street and inside market,
21e dey shaut dey koll dem from di town gate and anywhere wey pipol gada put.
22Pipol wey nor get sense, na how long una won take bi fool? Na how long una won take wisdom do yeye? Una nor won learn at-all?
23How I wish una go gri listin, den I for give una good advise kon share my wisdom with una.
24I dey koll and invite una since, but una nor gri listin or hear mi.
25Una nor gri take my advise or allow mi korrect una.
26So, I go laf una wen una enter trobol kon take una do yeye wen wahala start.
27Dat time, trobol go kom meet una like heavy breeze and una pain go sirious well-well.
28Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.
29Una nor ever get wetin to do with wisdom and una nor gri obey God.
30Una nor wont my advise or listin to mi wen I dey korrect una.
31So, una go get wetin fit una and wetin una do, go make una sick.
32Pipol wey nor know anytin, dey die bikos dem rijet wisdom and distroshon go follow doz wey bi fool, bikos dem feel sey wisdom nor koncern dem.
33But anybody wey listin to mi, go dey save and e nor go get rizin to fear.