Psalms 15pcm

1My God, na who go fit woship for yor temple? Na who go enter yor present for yor holy hill?

2Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite; pipol wey dey tok trut with pure heart.

3Doz wey nor dey judge odas, wound dia neighbours or tok bad about dia friends.

4Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God! Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.

5Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head. Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 15.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.