Psalms 16pcm

1My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.

2I tell my Oga God, “Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get, na Yu give dem to mi.”

3Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.

4Pipol wey dey run follow oda gods, dia trobol dey plenty evriday. I nor go follow dem do dia blood sakrifice or even koll dia god name.

5My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.

6Evritin dey work for my good! True-true, E don bless mi well-well.

7So I go bless God wey dey guide mi; even for nite, my heart dey happy to praiz am.

8I don make God nomba one for evritin wey I dey do and bikos E dey for my rite side, I nor go shake or fear anytin.

9No wonder happiness full my heart, bikos I dey rest well and fear nor dey my life.

10Bikos God nor go leave my soul inside grave or allow en holy pikin rotin for der.

11Yu don show mi di way wey dey give life kon give mi joy for yor present and I dey happy to stay with Yu forever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 16.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.