Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 14

:
Nigerian - pcm
1 Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem nor good at-all and dia ways bad well-well. No one among dem dey do wetin good!
2 God dey look evribody from heaven; E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.
3 But e nor dey, bikos evribody don turn from am; evribody don spoil finish. Nobody dey do good again. Yes! E nor get anybody at-all.
4 Doz wey dey do bad nor go ever learn? Dem dey chop my pipol like bread and dem nor dey pray to God.
5 So fear go katch dem, bikos God dey with di pipol wey dey obey am.
6 Even doh wiked pipol dey fight poor pipol, God go guide and protet dem.
7 E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.