Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 13

:
Nigerian - pcm
1 My God, Yu go forget mi forever? Na how long Yu go trowey yor face from mi?
2 How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart? Na how long my enemies go always dey opress mi?
3 My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.
4 Make Yu nor let my enemies dey make mout sey, “Wi don win am!” Den dem go dey happy sey I don fall.
5 But I trust yor love wey nor dey fail. I go happy, bikos Yu don save mi.
6 Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.