Bible

Power Up

Your Services with User-Friendly Software

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 12

:
Nigerian - pcm
1 My God, make Yu diliver mi! Bikos all doz wey dey fear and respet Yu, wiked pipol don kill dem finish.
2 Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.
3 Make God kut di tongue wey dey tok anyhow kon distroy di mout wey dey boast!
4 Dem dey sey, “Na di way wi dey tok, dey make us prosper; na wi get awa own lip: who bi awa oga or who go fit stop us?”
5 So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
6 God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire.
7 So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress. Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well,
8 even from doz evil pipol wey dey evriwhere, bikos wikedness don kover di whole land.