Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 11

:
Nigerian - pcm
1 I bilive and trust sey God go protet mi. So wetin make yu dey sey, “Fly like bird go hide for mountin, so dat yu go dey save,
2 bikos wiked pipol dey wound innocent pipol anyhow. Dem hide for darkness dey shot good pipol with dia bow and arrow.
3 So, naw wey di foundashon don skata, wetin good pipol go fit do?”
4 But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.
5 God dey si both good and bad pipol. E hate doz wey love wahala.
6 E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.
7 God dey good and E dey judge well; so E go favor doz wey dey do good too.