Psalms 141pcm

1My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom! Make Yu listin wen I kry to Yu for help!

2Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.

3My God, make Yu help mi kontrol my mout kon guide my lips.

4Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins. Nor let mi chop sweet food wey wiked pipol kook.

5Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.

6Wen dem trow dia leaders down from rock, di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.

7Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.

8But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu. Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.

9Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi; di hole wey wiked pipol dig.

10Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap and free mi from dia trobol.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 141.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.