Psalms 140pcm

1My God, make Yu save mi from wiked pipol! Protet mi from pipol wey like wahala;

2doz wey dey plan evil for dia heart and dey kause trobol waka.

3Dia tongue dey wound pipol like snake and dia lips dey bring out snake poizin.

4My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand. Make Yu protet mi from doz wey like wahala, bikos dem dey plan bad against mi.

5Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.

6So I tell Oga sey, “Na Yu bi my God!” So my Oga God, make Yu listin wen I dey kry for help!

7My God wey get pawa, di strong One wey save mi, na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.

8So make Yu nor let wiked pipol win mi, nor let dem susid with dia evil plan, if not, dem go dey proud.

9Make Yu distroy my enemies with di evil and wiked tins wey dem plan for mi.

10Make hot shako fall for dia head. Make Yu trow dem for fire or inside pit wey wota dey, where dem nor go fit komot or eskape.

11Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.

12But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol.

13True-true, pipol wey dey do wetin dey rite, dey praiz yor name and doz wey dey fear God, go stay for en present.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 140.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.