1My God, Yu shek my heart well-well and Yu know evritin about mi.
2Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.
3Yu dey si mi wen I dey travel and wen I dey rest for house. Yu know evritin wey I dey do.
4My God, Yu know wetin I won tok even before I tok am.
5Yu dey my front kon still dey follow mi for back and yor blessings dey my head.
6Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!
7I nor go fit hide from yor Spirit! I nor fit run komot from yor present at-all!
8If I run go heaven, Yu dey der; if I die go grave, Yu dey der too.
9If I sey make I fly as day dey break kon go di oda side for di sea,
10yor hand go guide mi for der and yor rite hand go support mi.
11Even if I sey, “darkness go kom and day go turn to nite around mi,”
12e nor get how di darkness dark rish wey Yu nor go fit si mi, bikos nite brite like day for yor eye and darkness and lite na di same tin to Yu.
13True-true, na Yu make my mind and my heart; na Yu arrange mi for my mama belle.
14I go tank Yu, bikos di tins wey Yu dey do, dey wonderful and dey sopraiz mi. Yu know mi well-well;
15my bones nor hide from Yu, even wen Yu make mi for sekret kon put mi for di eart.
16Yu dey si mi wen I dey my mama belle. All di days wey I go live, dem rite am for yor book, even before dem born mi.
17My God, si as e hard mi to tink about wetin Yu dey tink for mi, bikos dem plenty well-well!
18If I try to kount dem, dem go many pass san-san. Even if I kount dem finish, Yu go still dey with mi.
19My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish! So make wiked pipol leave mi alone o-o!
20Dem nor gri do wetin Yu kommand; dem like to dey do wiked tins and awa enemies dey like to lie well-well.
21So my God, si as I hate pipol wey hate and dey oppoz Yu!
22True-true, I really hate dem and dem don bi my enemies naw!
23Look mi well, den make Yu tell mi wetin I dey tink! Test mi and Yu go know wetin I wont!
24Show mi anytin wey make Yu dey vex for mi. So take mi pass di road wey dey give life wey nor dey end!