Psalms 138pcm

1My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.

2I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.

3Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.

4My Oga God, di king for di whole eart go tank Yu, bikos all of dem go hear yor words.

5Yes! Dem go sing about God ways, bikos en glory dey great well-well.

6Even doh God dey great, E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef, but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.

7Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.

8God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 138.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.