Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 138

:
Nigerian - pcm
1 My God, I tank Yu with all my heart; I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
2 I bow kon woship Yu for yor holy temple. I dey praiz yor name, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail; bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.
3 Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi! Yu enkourage mi kon give mi strent.
4 My Oga God, di king for di whole eart go tank Yu, bikos all of dem go hear yor words.
5 Yes! Dem go sing about God ways, bikos en glory dey great well-well.
6 Even doh God dey great, E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef, but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.
7 Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.
8 God go fight for mi. My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever, so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.