Psalms 137pcm

1As wi sidan near Babilon River, wi kon dey kry bikos wi dey tink about Jerusalem.

2Wi trowey and hang awa harps for poplar tree branches,

3bikos na for der di pipol wey katch us, sey make wi sing Jerusalem song for dem; dem even dey laf us kon sey make wi dey smile as wi dey sing am.

4But how wi won take sing God song for land where di pipol nor know God?

5O-o my Jerusalem, if I forget yu, make my rite hand die, so dat I nor go fit play harp again.

6If I nor remember Yu again or si Jerusalem as where my joy from dey kom, make my tongue gum my mout.

7My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”

8Babilon pipol! God go soon distroy una. Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us, make happiness bi en own.

9Di pesin wey go take una shidren dem take nak rock, make blessing follow am!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 137.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.