Psalms 136pcm

1Make wi tank God, bikos E dey good and en love wey nor dey fail, dey forever.

2Make wi tank God wey bi di oga of all gods, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

3Make wi tank di Oga God of all ogas, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

4Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

5Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

6Di Pesin wey put di eart on-top wota, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

7Di Pesin wey make di great lite for heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever:

8Di sun dey rule for day time, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,

9and di moon and star dey rule for nite, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

10Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

11Den E karry Israel pipol komot from der, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

12E guide dem with en strong hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

13Na-im divide di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

14Den E take Israel pipol waka pass di river for dry land, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

15Na-im make Fero and en sojas die inside di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

16Na God lead en pipol pass di wildaness, bikos en love wey nor dey fail dey forever.

17Di Pesin wey kill strong-strong kings for dem, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

18E still kill great and mighty kings too, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

19E kill King Sihon for Amor, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

20E kill King Og for Bashan, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

21Den E kon give dia land to en pipol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

22E give di land to Israel pipol wey bi en savant, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

23Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,

24den kon take us komot from awa enemies hand, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

25Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.

26So make wi tank di Oga God wey dey heaven, bikos en love wey nor dey fail, dey forever!

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 136.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.