Bible

Say Goodbye

To Clunky Software & Sunday Tech Stress!

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 142

:
Nigerian - pcm
1 I kry to God! I dey beg make E kom help mi.
2 I tell am all my komplain and trobols.
3 Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.
4 I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.
5 Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
6 Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.
7 Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”