1I kry to God! I dey beg make E kom help mi.
2I tell am all my komplain and trobols.
3Wen I nor get pawa again, na-im dey protet mi as I dey waka. Bikos anywhere wey I dey go, my enemies don set trap dey wait for mi.
4I dey look for di rite pesin wey go kom help mi, but nobody dey even tink go my side! Nobody to help mi; nobody even kare about wetin go happen to mi.
5Den I pray to Yu, my Oga God kon sey, “Na Yu dey guide mi. Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
6Make Yu hear my prayers, bikos I don taya. Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi, bikos dem too strong for mi.
7Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”