Psalms 130pcm

1My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart.

2My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!

3If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?

4But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.

5So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail.

6Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.

7So Israel pipol, make una put una hope for God hand, bikos God dey show en love and E always dey ready to save en pipol.

8E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 130.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.