Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 130

:
Nigerian - pcm
1 My God, I dey kry kom meet Yu with pain for my heart.
2 My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!
3 If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?
4 But Yu always dey ready to forgive so dat dem go honor Yu.
5 So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail.
6 Di way I dey find God, sirious pass as gateman dey wait make day break. Yes o-o, e sirious pass as gateman dey do for morning.
7 So Israel pipol, make una put una hope for God hand, bikos God dey show en love and E always dey ready to save en pipol.
8 E go diliver Israel pipol from di wahala wey dem dey face, bikos of dia sins.