Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 129

:
Nigerian - pcm
1 Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us.
2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us.
3 Dem don use cutlass kut all awa back like sey na farmer klear am.
4 But God dey good; E don kut di rope wey wiked pipol take tie us and naw, wi don dey free.
5 So, make evribody wey hate Jerusalem, turn back with shame.
6 Make dem dey yuzles like grass wey dey on-top roof, wey go die as e dey grow
7 and pipol nor go plok or si am again.
8 Yes! Pipol wey dey waka pass nor go sey, ‘Make Oga God bless dem’ or sey, ‘Wi bless una with Oga God name.’