Bible

Designed

For Churches, Made for Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 128

:
Nigerian - pcm
1 Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.
2 Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure.
3 Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree.
4 Yes! True-true, dis na God blessing for doz wey dey fear am.
5 Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.
6 Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land!