Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Psalms 125

:
Nigerian - pcm
1 Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.
2 Just as mountin gada round Jerusalem, na so too God dey round en pipol, both naw and forever.
3 Wiked pipol nor go rule pipol wey dey fear and obey God, if not, doz wey dey obey God fit start to do bad tins too.
4 My God, make Yu do good to pipol wey dey good; doz wey dia heart and mind dey with Yu,
5 but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!