Psalms 126pcm

1Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!

2Wi bigin laf kon dey sing for joy. So di oda nashons kon sey, “Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.”

3Yes, God don do betta tin for us, so awa joy don plenty!

4Oga God, just as wota dey make dry land fresh, na so too Yu go do for us wen Yu give us awa propaty back.

5Pipol wey sofa plant dia seed, go harvest wetin dem plant with happiness.

6Dem dey kry as dem dey go plant dia seed, but dem go dey sing with joy as dem dey kom back with wetin dem harvest.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 126.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.