Bible

Simplify

Your Church Tech & Streamline Your Worship

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 126

:
Nigerian - pcm
1 Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!
2 Wi bigin laf kon dey sing for joy. So di oda nashons kon sey, “Di Oga God don do good tin for dis pipol o-o.”
3 Yes, God don do betta tin for us, so awa joy don plenty!
4 Oga God, just as wota dey make dry land fresh, na so too Yu go do for us wen Yu give us awa propaty back.
5 Pipol wey sofa plant dia seed, go harvest wetin dem plant with happiness.
6 Dem dey kry as dem dey go plant dia seed, but dem go dey sing with joy as dem dey kom back with wetin dem harvest.