Bible

Create

Inspiring Presentations Without Hassle

Try Risen Media.io Today!

Click Here

Psalms 124

:
Nigerian - pcm
1 Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”
2 If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us,
3 dem for don swallow us alive as dem dey vex.
4 River for don kover us; wota for don karry us go.
5 Strong wave for river for don kover awa soul.
6 So, make wi praiz God wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit!
7 Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free!
8 God wey kreate heaven and eart, na-im diliver us from dia hand.