Psalms 123pcm

1My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.

2Just as savants dey depend on dia masta and as savant girls dey depend on dia madam, na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us.

3My Oga God, make Yu sorry and pity for us, bikos wi too don get awa own share for di trobol.

4Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 123.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.