Bible

Engage

Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 122

:
Nigerian - pcm
1 I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
2 And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem.
3 Jerusalem na strong town wey dem build well; so nor-tin go fit skata en wall.
4 Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
5 Di throne where God for dey judge kase dey for der; di throne wey bi David and en shidren-shidren own.
6 So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper.
7 My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever.
8 Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”
9 Bikos of awa Oga God house, I go pray make Jerusalem dey prosper.