1I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
2And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem.
3Jerusalem na strong town wey dem build well; so nor-tin go fit skata en wall.
4Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
5Di throne where God for dey judge kase dey for der; di throne wey bi David and en shidren-shidren own.
6So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper.
7My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever.
8Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”
9Bikos of awa Oga God house, I go pray make Jerusalem dey prosper.