Psalms 121pcm

1I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?

2My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart!

3E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.

4True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all.

5Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi.

6Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite.

7God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.

8God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 121.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.