Bible

Upgrade

Your Church Presentations in Minutes

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 121

:
Nigerian - pcm
1 I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?
2 My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart!
3 E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep.
4 True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all.
5 Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi.
6 Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite.
7 God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.
8 God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.