Psalms 120pcm

1Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.

2My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.

3Una wey sabi lie well-well, una know how God go take ponish una? Una know how una wahala go plenty rish?

4Dem go shuk una with sharp arrow kon burn una with hot shako from fire.

5I really sofa for Meshak town and e pain mi well-well sey I stay with Kedar pipol.

6I don taya to stay among pipol wey nor like peace.

7I dey look for peace; but wen ever I tok about am, na war dem dey give mi.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 120.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.