Bible

Focus

On Your Ministry and Not Your Media

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 120

:
Nigerian - pcm
1 Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.
2 My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas.
3 Una wey sabi lie well-well, una know how God go take ponish una? Una know how una wahala go plenty rish?
4 Dem go shuk una with sharp arrow kon burn una with hot shako from fire.
5 I really sofa for Meshak town and e pain mi well-well sey I stay with Kedar pipol.
6 I don taya to stay among pipol wey nor like peace.
7 I dey look for peace; but wen ever I tok about am, na war dem dey give mi.