Psalms 110pcm

1Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”

2God go make yor kingdom big and strong for Jerusalem and yu go rule ova yor enemies.

3Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.

4God don promise and E nor go break di vow wen E make sey: “Yu bi priest forever like Melkizedek.”

5Di Oga God stand for yor rite hand to protet Yu and E go kill many kings, wons E don dey vex.

6E go ponish di nashons and dead body go full dia land. Yes! E go kut pipol head full di whole world.

7But di king go drink from di wota wey dey flow pass for di road kon rule forever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 110.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.