Psalms 111pcm

1Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.

2Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.

3Evritin wey God dey do, dey show en glory and majesty; en raitiousness nor dey ever fail.

4E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!

5E dey give food to pipol wey dey obey am and E always dey remember en kovenant.

6E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.

7Evritin wey E dey do dey rite and good and pesin fit trust all en kommand,

8bikos dem bi true word and dem go last forever, so wi must obey dem well and respet dem.

9E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!

10Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 111.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.