Bible

Upgrade

Your Church Presentations in Minutes

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 111

:
Nigerian - pcm
1 Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
2 Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.
3 Evritin wey God dey do, dey show en glory and majesty; en raitiousness nor dey ever fail.
4 E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!
5 E dey give food to pipol wey dey obey am and E always dey remember en kovenant.
6 E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.
7 Evritin wey E dey do dey rite and good and pesin fit trust all en kommand,
8 bikos dem bi true word and dem go last forever, so wi must obey dem well and respet dem.
9 E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!
10 Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.