1My God wey I dey praiz, make Yu nor rijet mi
2as wiked pipol dey trobol and lie for my head.
3Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
4I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
5Dem dey pay mi bad for good and even doh I love dem, dem hate mi.
6Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am. Make una send pesin wey go tok against am for kourt.
7Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
8Make en years for life nor plenty and make anoda pesin take en pozishon.
9Make en shidren and wife nor get papa and husband again.
10Make en shidren beg waka and make dem porshu dem komot dia house.
11Make pipol wey e dey owe, kollect all wetin e get and make strenjas take evritin wey e work for.
12Make nobody pity for am; make nobody sorry for en shidren wey nor get papa.
13Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
14Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.
15Yes! Make God always dey remember en sins and make nobody remember en name again.
16Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.
17E love to curse odas. Naw, make Yu curse am. E nor dey ever bless odas; so naw, make Yu nor bless am.
18To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body or wota wey dem dey drink or betta food wey e dey chop.
19Naw, make en curse go back to am kon dey with am like klot for body; make dem tie am round am like belt for en waist.”
20But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.
21My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
22I poor well-well! I nor get anytin and na pain full my heart.
23I dey fade komot dis life like shadow; I dey die komot like lokust.
24Bikos I dey fast since, my legs don weak and my body don turn to ordinary skin and bone.
25Pipol for evriwhere dey use mi make yeye; wen dem si mi, dem dey shake dia head dey laf.
26My Oga God, make Yu help mi! Make Yu save mi, bikos of yor love wey nor dey fail.
27Make dem si sey, dis na wetin Yu do kon know sey na Yu my God, do am by yorsef.
28Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!
29Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
30But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
31bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.