Bible

Transform

Your Worship Experience with Great Ease

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Psalms 109

:
Nigerian - pcm
1 My God wey I dey praiz, make Yu nor rijet mi
2 as wiked pipol dey trobol and lie for my head.
3 Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
4 I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
5 Dem dey pay mi bad for good and even doh I love dem, dem hate mi.
6 Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am. Make una send pesin wey go tok against am for kourt.
7 Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
8 Make en years for life nor plenty and make anoda pesin take en pozishon.
9 Make en shidren and wife nor get papa and husband again.
10 Make en shidren beg waka and make dem porshu dem komot dia house.
11 Make pipol wey e dey owe, kollect all wetin e get and make strenjas take evritin wey e work for.
12 Make nobody pity for am; make nobody sorry for en shidren wey nor get papa.
13 Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
14 Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.
15 Yes! Make God always dey remember en sins and make nobody remember en name again.
16 Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.
17 E love to curse odas. Naw, make Yu curse am. E nor dey ever bless odas; so naw, make Yu nor bless am.
18 To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body or wota wey dem dey drink or betta food wey e dey chop.
19 Naw, make en curse go back to am kon dey with am like klot for body; make dem tie am round am like belt for en waist.”
20 But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.
21 My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
22 I poor well-well! I nor get anytin and na pain full my heart.
23 I dey fade komot dis life like shadow; I dey die komot like lokust.
24 Bikos I dey fast since, my legs don weak and my body don turn to ordinary skin and bone.
25 Pipol for evriwhere dey use mi make yeye; wen dem si mi, dem dey shake dia head dey laf.
26 My Oga God, make Yu help mi! Make Yu save mi, bikos of yor love wey nor dey fail.
27 Make dem si sey, dis na wetin Yu do kon know sey na Yu my God, do am by yorsef.
28 Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!
29 Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
30 But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
31 bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.