Psalms 108pcm

1My God, I don make up my mind! I go sing and praiz Yu with all my heart!

2Jita and trumpet, make una wake-up! I go wake-up for early morning kon praiz Yu with song from my mout.

3My God, for evribody present, I go tank Yu. I go sing yor praiz among di nashons.

4Bikos yor love wey nor dey fail, high pass di heavens. Yor faithfulnes dey rish di kloud.

5My God, make all praiz bi yor own and make dem high pass di heavens. Make yor glory kover di whole eart.

6Naw, make Yu save di pipol wey Yu love. Make Yu ansa and save us with yor pawa.

7As God holy rish, E kon promise sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.

8Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings.

9But Moab na my wosh-hand basin; dem bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.”

10So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol?

11My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go fight war again?

12Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help, dey yuzles

13and wi know sey, with God help, wi go do mighty-mighty tins, bikos E go distroy all awa enemies.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Psalms 108.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.