Micah 5
1 Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.
2 But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
3 God go give Israel pipol to dia enemies until di woman wey dey labor go born. Den en own kountry pipol go kom back to dia land from Babilon.
4 Wen e kom, e go lead di pipol with God strent, pawa and name. Den en pipol go stay for peace, bikos dem go dey honor am for evriwhere for di world.
5 E go give us peace. Wen Assyria pipol kom attack and break enter awa town, wi go choose seven rulers wey go wosh ova us and eight priests wey go lead us.
6 Dem go rule Assyria with dia swod kon enter Nimrod land. E go save us from Assyria pipol wen dem kom attack us.
7 Den Israel pipol wey survive go bi like dew for morning wey God send kom di nashons; like rain wey go make plant grow and e nor dey wait for man before e fall.
8 Doz wey remain for Israel go skata go oda nashons and dem go bi like lion among animals for bush; like yong lion wey dey mash and kill oda animals without who go save dem.
9 Israel pipol go stand fight dia enemies kon kill all of dem finish.
10 God sey, “For dat time, I go kill una horse and distroy una shariot dem.
11 I go skata una wall kon distroy una pawa.
12 I go stop all di wiked tins wey una dey do and nobody go help una dey si vishon again.
13 I go distroy and skata una juju pilas, den una nor go ever woship di work wey una take una hand make.
14 I go skata una juju shrine with dia Asherah juju kon distroy una towns.
15 I go revensh and ponish all di nashons wey nor gri obey mi.”