Micah 4pcm

1For di last days, di mountin where God temple dey, na-im go high pass all di mountins. E go high pass di hills too and pipol from evry nashon go dey rush go der go woship God.

2Pipol from many nashons go kom and dem go sey, “Make una kom make wi go di Oga mountin wey bi Jakob God house, so dat E go tish us en laws and wi go do evritin just as E wont am.” Nor bi only di pipol for Zion and Jerusalem go hear God word, but oda nashons go hear am too.

3God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.

4Evribody go stay for peace and dem go prosper. Dem go enjoy dia own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!

5Even doh di nashons around us dey serve dia juju, wi go woship and obey di Oga awa God forever and ever.

6God sey, “Di time dey kom wen I go gada doz wey nor fit waka; wey bi slave for anoda kountry and doz wey nor happy at-all.

7Doz wey dey weak, go survive and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry, go kon bi one strong nashon. Den mi wey bi God go rule Jerusalem as dia king forever.”

8But Jerusalem; di place where nor-tin bad go happen to God pipol, yor royal strent and pawa go kom back again. Di king go get pawa for Jerusalem again.

9But naw, wetin make una dey shaut and kry? Una nor get king to lead una? Abi dem don kill una wise men finish? So wetin make una dey feel pain like woman wey won born?

10Jerusalem pipol, make una shaut and kry like woman wey won born, bikos dem must karry una go Babilon as slave. But God go save una for der; E go save una from una enemies hand.

11Naw, many nashons don gada against una kon sey, “Make dem skata di town! Make wi look as dem dey distroy Jerusalem.”

12But dem nor know wetin God dey tink; dem nor undastand en plans. Dis pipol nor know sey God dey gada dem, so dat dem go beat and mash dem pass like korn wey dem mash for groun.

13God sey, “Jerusalem! Make yu raiz-up kon skata di nashons, bikos I go give yu iron and bronze horn, so dat yu go fit distroy many nashons! Yu go give di propaty and di money wey dem tif to Oga God wey dey rule di eart.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Micah 4.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.