Micah 6
1 Make una listin to wetin God dey tok: “Make una stand up kon tok wetin I do una. Make di mountins and hills bi witness to wetin una dey tok.
2 Naw, make di mountins listin to God! E get kase against en pipol. E go tok wetin Israel pipol do.
3 My pipol, wetin I do una? Wetin I do wey make una taya for mi? Make una ansa mi naw!
4 Na mi bring and save una from Egypt where una for bi slave. I send Moses, Aaron and Miriam kom help una.
5 My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”
6 Na wetin wi fit give God? Na wish kind ofrin wi won gi-am? Make wi bow woship God with melu ofrin?
7 Make wi gi-am tazon rams and 10,000 river wey full with olive oil? Make wi sakrifice awa first-born gi-am to take pay for awa sins?
8 No! My pipol, God don tell una wetin dey good and wetin E wont from una, na to dey do wetin dey rite; show love; dey obey and respet am.
9 If una dey wise, make una fear God! E dey koll evribody from Jerusalem sey: “Di sojas wey go distroy, dey kom and na God dey send dem kom so.
10 Wetin I wont tok about wiked pipol house wey full with propaty wey dem kollect thru wayo? Dem dey shit pipol for market and I hate dat kind tin.
11 How I won take bilive una wey dey sell and measure with wayo cup?
12 Di rish pipol among una dey get more money thru wayo and wikedness. Una pipol don too good with lie and trut nor dey dia tongue again.
13 So, I go wound una! I go distroy una, bikos of all di sin wey una don kommit.
14 Even wen una chop, e nor go ever beleful una and una go still dey hongry like sey una neva chop at-all. Even doh una dey try to save money, e nor go mean anytin for di end. Una go save small, but I go gi-am to doz wey go distroy una.
15 Even wen una plant, una nor go harvest anytin. Una go press una olive fruit, but una nor go get enough oil to anoint unasef. Una go mash di grape, but una nor go get any wine to drink.
16 Una dey obey only King Omri wiked laws and una wiked like King Ahab! So, I go use una as ezample kon distroy una finish. Dem go ponish una and evribody wey si una, go laf well-well.”