Job 9pcm

1Den Job ansa:

2“Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?

3Wetin go make pesin argue with God? E go fit ask God kweshon wey E nor go fit ansa?

4God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.

5E dey move mountins anytime E wont kon skata dem with vexnashon.

6God wey shake di eart komot from where e dey! E shake di pilas wey support di eart.

7Di One wey kommand di sun and di sun nor raiz; di stars sef nor shine for nite.

8Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.

9Na God make di Bear, Orion, di Pleiades and di sky for sout.

10Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.

11Even if God pass naw, I nor go fit si am. If e waka pass, I nor go even smell am sef.

12Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take. Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’

13If God dey vex, nobody go fit stop am. Even juju for wota dey under en leg.

14“So, na how I won take find word take ansa God?

15Even if I nor do any bad tin, di only tin wey I fit still do na to beg for mesi from God wey bi my judge.

16Even if I koll am and E ansa mi, I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.

17E send breeze kom attack and wound mi, even doh I nor do any bad tin.

18E nor let mi breath well; E don kover my life with bitterness.

19Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?

20I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.

21I know kare again, life don taya mi, bikos I know sey I nor do any bad tin.

22“All of dem na di same! Na dis make mi dey sey, E dey distroy both who nor do anytin and di ones wey dey do bad tins.

23Wen pesin wey nor do bad tin die like dat, God go just dey laf.

24God don give dis eart to wiked pipol kon kover all di judge dem face. If nor bi en do am, den na who fit?

25“No day good for my life since dem born mi and dem nor dey last.

26My life just dey rush pass like speed boat; like eagle wey won katch rabbit.

27If I tok sey I go forget my komplain or I go try to dey happy,

28my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.

29If I dey guilty, wetin go make mi komplain?

30Even if I use soap wosh my body and make my hand klean well-well,

31Yu go still trow mi put for dirty pit and even di klot wey I wear, go rijet mi.

32If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.

33Nobody fit setol us! Nobody go fit setol mi and my God.

34Who go fit stop god make E nor ponish mi again, so dat e nor go make mi fear again.

35Den I nor go fear as I dey tok, but naw, nor bi so e bi with mi.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 9.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.