1Bildad wey kom from Shuah kon sey:
2“Job, wen yu go stop to dey tok like dis, wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
3Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
4Yor shidren go don sin against God, naim make am pay dem for dia sin.
5But if yu look up to God kon beg di Oga wey dey mighty;
6if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.
7Yor biginnin fit dey small for eye naw, but yor ending go betta well-well.
8Make yu ask generashons wey don pass; tink and follow di trut wey dem sabi;
9bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.
10But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:
11Papyrus plants fit grow for where river nor dey? Abi reed fit grow without wota?
12If wota dry, na dem go first die wen e neva rish to kut or use dem.
13Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.
14Dem bilive bad-bad tins and dia sekurity bi like spider house.
15If dem rest for spider house, e go fit hold dem? If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
16Wiked pipol plenty like betta grass for sun wey dem dey wota, wey skata around di gardin.
17Dem wrap dia rut for plenty stone kon dey look for where dem go hide put for di rock.
18But if dem rut dem komot for dia place, dat place go rijet dem kon sey, ‘I neva si una before!’
19Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get and from inside di eart, odas go kom take dia place.
20But God nor go ever help wiked pipol kon let pesin wey dey fear am, sofa.
21E go pak laf full yor mout and yor lip go dey happy.
22But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”