1“Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish.
2I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
3E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do?
4“Yu dey si tins di wey wi dey si dem? Abi Yu get di kind eye wey human being get?
5Yor life short like awa own? Abi yor years know long life awa own.
6Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?
7Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.
8“Na di same hand wey Yu take make mi, Yu won take skata mi?
9Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again?
10Na yor pawa my papa take born mi; na Yu make mi grow for my mama belle.
11Yu make my body with bone kon kover am with flesh and skin.
12Yu don give mi life kon show mi yor love wey nor dey die. Na bikos yu kare for mi naim make mi still dey alive.
13But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi.
14Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
15If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so.
16If I sey make I karry body up, Yu go porshu mi like lion and na mi Yu go use take show yor pawa.
17Yu must get pipol wey go tok against mi; yor vexnashon dey big evriday by day and na new attack Yu always dey plan for mi.
18“God! Why Yu let my mama born mi? I for don die, before anybody si mi.
19To die for my mama belle, for betta pass dis one wey I dey so.
20Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get.
21I go soon go di land where Yu nor go fit si mi and I nor go kom back again.
22I go-go di dark place where dead pipol and konfushon dey. Place where lite nor dey-dey.”