1“Job, make yu koll naw, if anybody go ansa yu? Na who dey holy wey yu won go meet?
2Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
3I don si sey fool fit dey progress, but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get.
4Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt.
5Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.
6Evil nor dey grow from dust or trobol from groun.
7But just as lite dey shine go up, na so too dem born pesin enter trobol.
8“But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am.
9Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.
10E dey give rain to di eart and wota for di san.
11Na God dey karry doz wey dey honbol go up and give joy to doz wey dey mourn.
12E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan!
13E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.
14Dem dey waka for darkness for day time. For aftanoon, dem dey waka dey find road like sey dem dey darkness.
15But na God dey save poor pipol from deat. E dey save doz wey nor get, from doz wey get pawa.
16E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol.
17Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.
18God go kover where E for wound yu; na en hand wound yu and na dat same hand E go take heal yu.
19E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.
20Wen honga kom, E go keep yu alive; wen war kom, E go protet yu, so dat yu nor go die.
21God go diliver yu from trobol; E go save yu wen distroshon kom.
22Yu go laf trobol and honga; yu nor go fear wiked animals again.
23Di land wey yu klear go dey free from stones and wild animals nor go kom near am.
24Peace go dey yor house and wen yu look yor propaty, evritin go komplete.
25Yu go get many shidren! Dem go plenty like grass for dis eart.
26Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die.
27Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”