Job 4pcm

1Elifaz from Teman kon sey:

2“Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again.

3Si, yu don tish many pipol and give strent to doz wey dey weak.

4Yor words don support pipol wey won fall and yu don give strent to doz wey don taya.

5Naw wey e rish yor turn to face trobol, yu nor get heart again. Yu nor fit stand am at-all.

6Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.

7Make yu tink am sef, den tell mi wish time pesin wey dey respet God, dey sick.

8But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.

9God dey skata doz kind pipol, bikos E dey vex for dem.

10Wiked pipol dey do like lion, but God go skata and break dia tit.

11Dem go die like lion wey nor si food chop and all dia shidren go skata.

12My savant kom tell mi word small-small, but I nor hear wetin e tok well.

13E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep.

14I fear and all my body kon dey shake.

15Na small breeze blow my face kon make my hair stand.

16Sometin stand for der and even wen I look, I nor fit si wetin e bi.

17E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?

18If God nor even bilive en savants wey dey heaven; dey si komplain for en angels body,

19yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house?

20Somebody fit dey alive for morning kon die for nite, before odas go know.

21Dem go take evritin wey e get and e die without wisdom.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 4.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.