Job 6pcm

1Den Job ansa:

2“If dem put my trobol and pains for skale,

3dem go heavy pass san wey dey for sea, bikos dem dey heavy and na dis make knee dey tok like dis.

4God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.

5Donkey dey fear wen e dey chop grass? Abi melu dey kwayet wen e dey near food?

6But who fit chop food wey nor get salt or taste? Or wish kind taste dey for di white part for egg?

7I nor fit tosh dat kind food, bikos e dey make mi sick.

8“Why God nor gri give mi wetin I ask for? Why E nor ansa my prayer?

9I wish sey God go distroy mi! I wish sey E go just kill mi with en hand.

10Aldo I get mind with dis sey: Even with all di pains wey I get, I neva ever go against God word.

11Wish kind pawa I get to still dey alive? Why I still dey live wen I nor get hope?

12Na stone dem take make my strent? Abi my body na bronze?

13I nor get strent to take help mysef and all my pawa don komot from my body.

14“Pesin wey dey face dis kind trobol, e suppose get betta friends; weda e forget God or not.

15But my friends, una don show sey una bi like wota wey dry bikos rain nor fall!

16Di wota dark bikos ice-blok and snow don kover dem.

17But wen hot weda kom, di wota go disappear. Wons heat dey, di wota go vanish from where dem dey.

18Animals wey dey pul karavan waka lost, bikos dem dey find wota and dem waka die for dry land.

19Animals wey dey pul karavan wey kom from Sheba and Tema nor find dem,

20but all dia hope die for dry river.

21To misef, una bi like dat wota; una si fear kon bigin shake.

22“I don ever sey, ‘Make una give mi sometin, or make una give money to pesin for mi?

23Or make una save mi from my enemy pawa and from wiked pipol?’

24“Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.

25True word dey pain o-o! But wetin yu dey tok nor make sense.

26My own word wey bi true nor dey good, but na di yuzles words yu like.

27Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.

28Make yu look mi for face, I nor go lie give yu.

29Yu don try well-well, stop to tink bad tins Nor kondemn mi again, bikos I dey rite.

30Yu feel sey I dey lie? Yu feel sey I nor know rite from wrong?

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 6.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.