Job 37pcm

1“My heart kom dey beat fast-fast as I bigin tink of dis tins.

2Make all of una listin to God vois. Make una listin to di tonda wey dey kom out from en mout.

3Na-im send lite go cross di sky; from one end go rish di oda end for di world.

4Dat time, una go hear di vois well-well kon si di brite tonda lite as e dey pass.

5Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.

6Na-im dey kommand snow and heavy rain sey, make dem dey fall for di eart.

7Na only en fit stop di work wey wi dey do, so dat wi go know how E strong rish.

8Den animals go-go dia house kon stay der.

9Heavy rain dey kom from sout, while strong kold breeze dey kom from nort.

10Wen God breath, wota dey turn to block! Di wota dey block finish!

11E load di kloud with wota and lite dey flash kom out

12as di kloud dey go where God sey make e go. Di kloud dey do evritin wey God kommand for dis world.

13God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.

14Job, make yu wait small kon listin; konsida all di wonderful tins wey God don do,

15den yu go know how God take dey give kommand and how E take make di lite flash for di kloud.

16Yu know how di kloud take hang for sky? Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.

17Wen yu dey sweet well-well bikos of di heat wey di sout wind dey bring,

18yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?

19Make yu tish us wetin wi go tell God, bikos wi nor get anytin for mind to tok.

20Make dem go tell God sey I won tok to am? Pesin even fit tok wen e konfuse?

21Naw, di lite for sky brite well-well and wi nor fit look am, bikos breeze don swip di eart klean.

22Na golden lite wi dey si for di nort and na glory kover us for God present.

23Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.

24No wonder evribody dey fear am and E nor get anytin to do with pipol wey feel sey dem wise.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 37.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.