1Elihu still sey:
2“Make yu relax and listin to mi small, bikos I still get some tins to tok for God, as E nor dey here with us.
3I go use wetin I know take show sey God dey rite. I go tok di ones wey I know.
4My words nor bi lie; na betta wise man stand for yor front so.
5True-true, God strong well-well! E nor dey feel sey pesin nor dey yuzful and e nor get anytin wey E nor undastand.
6E nor dey give wiked pipol long life, but E dey judge well for poor pipol.
7E dey protet good pipol; E dey let dem live like kings and pipol dey respet dem forever.
8But if dem shain dem inside prison and dem dey sofa, bikos of wetin dem do,
9God go show dem di rizin. E go show dem dia sin and pride.
10E go make dem listin to en warnin, so dat dem go leave wiked tins.
11If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper.
12But if dem nor gri listin to God word, dem go die and dem nor know anytin before dem go where dead body dey.
13Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem.
14Dem dey die wen dem still yong and na disgrace dey end dia life.
15But God use sofa take dey tish and save en pipol kon korrect dem with pain.
16God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.
17But naw, yu dey get di kind ponishment wey fit yu.
18Make yu dey kareful, so dat dem nor go fool yu with money or sey yu follow money go di wrong way.
19E nor go do yu any good sey yu dey kry for help; bikos yu get betta pawa wey nor fit help yu.
20Nor dey wait for nite, wen pipol don go dia house.
21Make yu dey kareful, so dat yu nor go do bad tin, bikos yu dey sofa.
22Make yu remember how God strong rish, bikos na-im dey tish tishas.
23Nobody fit kommand God or akuiz am sey E do bad tin.
24Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am.
25Evribody don si wetin E do! Na from far wi dey look am.
26“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.
27Na God dey take wota from di eart kon turn am to rain.
28E dey let di rain fall from di kloud, so dat pipol go prosper as dem dey work.
29Nobody know how tonda take dey make nois for di sky or how kloud take dey waka for heaven where God dey.
30E dey send lite pass di sky, but under di sea dey-dey dark.
31Dis na how E dey feed and provide plenty food for pipol to chop.
32Na en hand E take dey stop tonda lite kon send am go where E wont.
33Even animals know sey tonda kom before heavy rain dey fall.