Job 35pcm

1Elihu still sey:

2“Job, e dey rite make yu dey sey yu nor do any bad tin for God eye?

3Or to ask God sey, ‘Wetin I go gain if I nor sin? Any nid dey to live klean life?’

4I go ansa yu and all yor friends.

5Make una si how di kloud high rish! Make una look di sky well-well!

6If yu sin, e nor give God any trobol. Even if yu kontinue to dey sin, e nor go shake am.

7Even if yu dey good well-well, na God yu dey favor? E nor get wetin God wont for yor hand.

8Just as yor wikedness dey affect only pipol wey dey do like yu, na so too di good wey yu do, go affect doz wey dey do good.

9Bikos of di opreshon wey pipol dey sofa from strong pipol, dem dey kry for help.

10But dem nor dey kry to God wey kreate dem; wey dey give dem hope for darkness.

11Dem nor dey turn to God wey make us get sense; di One wey make us wise pass animals and birds.

12Dem dey kry for help, but God nor dey ansa dem, bikos dem too proud and dem dey do bad tins.

13E nor get nid for dem to kry; bikos God nor dey si or hear dia kry.

14Yu sey yu nor fit si God; but make yu dey patient, bikos yor matter dey en hand.

15Yu sey, ‘Wen God vex, E nor dey ponish pipol, bikos E nor dey kare about di bad tins wey dem dey do.’

16But Job! No nid for yu to dey tok, bikos e klear sey yu nor know wetin yu dey tok about.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 35.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.