1Elihu still sey:
2“Wise men, make una listin to my words; Make una hear mi, men wey know well-well.
3Una know betta food wen una put am for mout, but una ear nor know wise word wen e hear am.
4So make wi choose wetin dey rite. Make wi know among awasef wetin dey good.
5Job sey en know do bad tin and God nor gri defend am.
6E sey, ‘As I dey rite so, make I lie sey I dey wrong? Dem nor fit heal my wound, even doh I nor sin at-all.’
7Yu don si any man wey bi like Job wey dey tok anyhow?
8E like make bad pipol dey stay with am and e dey waka with sinnas.
9E sey pesin nor dey gain anytin, if e dey obey God.
10“Men wey dey undastand, make una listin to mi! God Almighty go fit do wetin dey wrong?
11E dey reward pipol for wetin dem do and dey trit dem as dem deserve.
12True-true, God nor dey do bad tin; E dey judge evribody as e suppose bi.
13Abi God get en pawa for anoda place? Na somebody tell am sey make E kare for di world?
14If God remove di breath wey dey give us life,
15den evribody wey dey live for dis life go die kon turn to san.
16“Naw, make yu listin to mi. If yu get undastandin, make yu hear mi.
17So yu dey tok sey God nor dey rite naw? Yu feel sey E hate justice?
18God dey kondemn kings and rulers wey wiked and nor dey yuzful.
19E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.
20Pesin fit die for nite just like dat, but God nor dey struggol to distroy pipol wey tink sey dem get pawa.
21God dey si evritin wey wi dey do. E dey si evry step wey wi take.
22E nor get as di darkness tick rish, e nor fit hide sinnas from God.
23Wi nor fit set di time wey God go take judge all of us.
24E nor nid pesin to tell am anytin, before E go remove leader kon put anoda pesin for en post.
25Bikos E know wetin di leader do. E fit ova-trow and skata dem for nite.
26E dey ponish sinnas bikos of dia sin and na for where evribody go for si dem,
27bikos dem don stop to follow en laws and kommand.
28Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.
29If God sey E nor go do anytin, nobody go fit ask am kweshon. If E hide en face, wi nor go get help at-all weda na one pesin or di hold kountry.
30God dey do like dis, so dat wiked pipol nor go rule and opress di pipol.
31“Wetin make pipol nor dey konfess dia sins give God kon promise sey dem nor go sin again;
32den tell mi my fault so dat I nor go do dem again?
33Job! Na yor choice, nor bi mi go tell God wetin yu wont, bikos yu don rijet all dis tin. Naw, make yu tell us wetin yu dey tink.
34True-true, anybody wey get sense go gri and if wise man hear mi, e go tok sey,
35Job just dey tok, bikos e nor know wetin e dey tok and all wetin e dey tok, nor make sense.
36But I wish sey dem test Job rish di end, bikos e dey ansa like wiked pesin.
37E don add trobol join e sins, bikos for awa front, e dey klap en hand and dey akuiz God.”