1“Job, make yu listin and hear evritin wey I won tok!
2Si naw, I don open my mout and my tongue won start to tok.
3All my words na true and na true I go tok.
4Na God Spirit make mi and na en breath give mi life.
5Make yu ansa mi if yu fit. Make yu dey ready and prepare yor kweshons.
6Na di same tin mi and yu bi for God eye, na san dem take make mi and yu.
7So yu nor get rizin to fear mi and I nor go wahala yu too mush.
8“Naw, dis na wetin I hear wen yu dey tok:
9‘I nor dey guilty; I neva do any bad tin or kommit sin.
10But God dey find rizin make E for dey ponish mi like sey I bi en enemy.
11E tie my leg with shain; E dey si evriwhere wey I waka go.’
12But I won tell yu sey yu dey wrong, bikos God big pass evribody.
13Why yu dey akuiz God sey E nor dey ever ansa yor komplain?
14“Even as God dey tok evritime, nobody won wait listin to wetin E dey tok.
15For nite wey pipol dey sleep, God dey tok to dem for vishon or thru dreams.
16Wen E make dem listin to wetin E dey tok, dem go dey fear for di warnin wey E dey give dem.
17God dey tok so dat dem go stop to sin kon honbol demsef, make E for fit save dem.
18E nor go let dem distroy demsef; E go save dem from deat.
19God dey send sickness to take korrect some pipol and dem go take korreshon wen dia body dey feel di pain.
20Pipol wey dey sick nor fit even chop di food wey sweet well-well.
21Dia body dey die go and yu nor go fit si dia bones again.
22Dem go soon go join dead body. Deat angel dey wait for dem.
23May bi one angel go help am; one out of di tazon angels wey God get wey go tell am wetin dey rite.
24Bikos God don forgi-am, di angel go sey, ‘Release am! E nor go fit go join dead body. Si wetin dem take replace en sin, so e don dey free.’
25En body go kom yong and strong again like small pikin own.
26Den wen e pray, God go ansa am. E go woship God with happiness. God go make am dey raitious for en eye again.
27Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’
28E don save mi from deat and I still dey alive.
29“True-true, God dey always do like dis, many-many times with pipol.
30E dey save pesin life from deat and make am enjoy life again.
31So Job, make yu listin to wetin I dey tok. Naw, kwayet make yu let mi tok.
32But if yu get wetin yu won tok, tok and I go tell yu if yu dey rite.
33But if yu nor get, make yu kwayet listin to mi and I go tish yu wisdom.”