Job 38
1 God kon ansa Job from inside di storm:
2 “Who yu bi to kweshon my wisdom with yor empty words?
3 Naw, make yu stand like man kon ansa di kweshons wey I go ask yu.
4 “Yu dey der wen I kreate di heavens and eart? If yu know well-well, tell mi about dem.
5 Na who tok how dem go big rish? Who measure dem with tape? Yu know di ansa?
6 Na wetin hold di pilas wey dey support di eart? Na who put di korner-stone for di world,
7 wen doz wey dey stay heaven dey shaut for joy and for morning, di stars dey sing togeda?
8 Who klose di sea mout wen e won komot from di eart belle?
9 Na mi kover di sea with kloud kon gada di darkness.
10 I give di sea where e go flow rish kon put big gate for en back.
11 I tell am sey, ‘Na here yu go rish and yu nor go pass der! Na here yor pawaful wave go for stop.’
12 For yor life, yu don ever kommand morning or tell di day wen e go break?
13 Abi yu don kommand day make e seize di eart kon shake wiked pipol komot from where dem hide put?
14 Na day lite make di hill and valley stand like klot wey dem fold and evritin klear like wetin dem rite for groun.
15 Day lite too brite for wiked pipol and e dey stop dem to make trobol.
16 Yu don rish where di wota wey dey full di sea dey? Abi yu don waka for under sea before?
17 Anybody don ever show yu di gate wey dey guide where dead body dey?
18 Yu know how di world big rish? Ansa mi, if yu know!
19 Yu know where di lite from dey kom or wetin dey bring darkness out?
20 Yu fit show dem how far dem fit go or send dem go house?
21 I dey sure well-well sey yu fit, bikos yu don old, wise well-well and dey der wen I kreate di world!
22 Yu don ever go where I dey keep di snow and di ice-blok rain, put?
23 I keep dem dey wait di time wen trobol go kom and di day wen war go start.
24 Yu don rish di place where sun from dey kom or di place wey east wind for dey blow kom?
25 Who dig pit for di rain wey dey fall kon klear road for tonda nois?
26 Who make di rain dey fall for where nobody dey stay?
27 Who dey wet di dry land with wota, so dat di grass go grow?
28 Abi di rain or dew get papa?
29 Ice-blok and kold wey dey fall kom from di sky, na who bi dia mama?
30 Wish time wota take strong like stone; wen sea bigin dey turn ice-blok?
31 Yu fit luz di klot wey dey Orion waist or yu won shain Pleiades?
32 Yu fit guide di stars from one sizin to anoda kon lead di big and small Bear?
33 Yu know di law wey dey tell di sky wetin to do? Or wetin dey make di laws work for dis eart?
34 Yu fit kommand di kloud kon sey make rain bigin fall?
35 If yu kommand lite make e flash, e go ansa yu sey, ‘I go do evritin wey yu tok?’
36 Na who put wisdom for pesin heart or make us dey undastand tins?
37 Who fit kount di kloud, bikos e feel sey e wise kon tell dem sey make rain fall;
38 rain wey dey make strong and dry groun soft?
39 Na yu dey give lion food make dem chop, or dey make small lion beleful
40 wen dem hide for dia hold or just sleep dey wait for dia house?
41 Na who dey feed raven bird wen dem dey waka dey find food for evriwhere? Even wen dia small shidren dey kry give mi sey dem dey hongry, na yu dey feed dem?