1Job ansa:
2“Si how yu don help pipol wey nor get pawa. Yu don save pipol wey nor get strent at-all!
3Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools, like mi!
4Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok? Na wish spirit make yu dey tok like dis?
5“Dead body dey shake with fear for dia grave. Evritin wey dey inside wota dey shake too.
6Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
7God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.
8Na God put wota for di kloud and E nor dey let rain fall from di kloud with force.
9Na-im use di kloud take kover di moon.
10E kreate di sky wen E separate di wota and divide lite from darkness.
11As God tok, di pila wey hold di sky kon dey shake with fear.
12Na en pawa E use take silent di sea. Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju.
13Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.
14But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”