Bible

Connect

With Your Congregation Like Never Before

Try RisenMedia.io Today!

Click Here

Job 26

:
Nigerian - pcm
1 Job ansa:
2 “Si how yu don help pipol wey nor get pawa. Yu don save pipol wey nor get strent at-all!
3 Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools, like mi!
4 Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok? Na wish spirit make yu dey tok like dis?
5 “Dead body dey shake with fear for dia grave. Evritin wey dey inside wota dey shake too.
6 Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye.
7 God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space.
8 Na God put wota for di kloud and E nor dey let rain fall from di kloud with force.
9 Na-im use di kloud take kover di moon.
10 E kreate di sky wen E separate di wota and divide lite from darkness.
11 As God tok, di pila wey hold di sky kon dey shake with fear.
12 Na en pawa E use take silent di sea. Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju.
13 Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake.
14 But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”