Job 25pcm

1Bildad kon sey:

2“Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace.

3Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish?

4Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?

5For God eye, even di moon nor brite and di stars nor shine rish.

6Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 25.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.