Job 27pcm

1Job still sey:

2“As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,

3as far I dey breath and God still give mi life,

4my mout nor go ever tok bad and my tongue nor go ever tok lie-lie words.

5I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.

6I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.

7“Make all my enemies, sofa like wiked pipol and doz wey nor know God.

8Doz wey nor know God before dem die, na wish kind hope dem get?

9Wen trobol go kom, God go hear dia kry?

10God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?

11Make I tish yu how God pawa strong rish. Make I tell yu about di Almighty God plan.

12But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”

13Zofar ansa, “Na so God take dey ponish pipol wey dey like trobol and do wiked tins.

14If dia shidren many, dem go die for war and di ones wey remain nor go si food chop beleful.

15Di ones wey manage survive, na sickness go still kill dem and dia wife nor go kry for dem.

16Wiked pipol fit get plenty money like san, dia klot fit plenty pass evribody own,

17but na good pipol go wear dia klot kon kollect dia money.

18Wiked pipol dey build house like spider own or like where hunta dey stay.

19E go sleep as rish man, but wen e wake-up, e nor go si en money again.

20Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go and for nite, breeze go blow dem trowey.

21Strong wind from east go swip dem komot from dia house

22and as dem dey try to run, God nor go sorry for dem and E go blow dem fall.

23Strong breeze go push dem as dem dey run and with en pawa, e go porshu dem komot from where dem dey.”

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Choose Translation

Switch translation for Job 27.

Reading Settings

Paragraph viewDisplay verses as flowing paragraphs instead of individual lines
Show verse numbersDisplay verse numbers inline
Red letterHighlight the words of Christ in red

Sign in to save your reading preferences across sessions.